Categories: Revamp

Pere BBN dey complain say food don finish. #hungerstrike.

Pere BBN begin this morning by showcasing him knowledge for nurse work from him experience as Nurse for Yankee. Apart from nurse work, Pere BBN don also serve for the US army wey dem even deploy am go Afghanistan and act some films for Yankee. So this morning Pere come dey lecture him guys Boma BBN and co about how salt they take affect high blood pressure. According to Pere BBN, him no dey put salt for food Kpata Kpata, say if him dey cook for himself, na by force him dey add one maggi because him no care if the food make sense, as far as say him go live long life.

Read On: Salt and health

The Shine ya eye Housemate them don finish food oo, according to Pere BBN

A profile picture of Pere Egbi

Pere BBN come follow dey explain say him no believe say biggie and the organizers of big brother naija go give them food wey no reach them for the first week. For my mind, I just dey laugh, Him never see anything. Make them lose wager first.

In addition to mercilessly chopping the food wey Big Brother give them, the housemates follow waste the food, in fact na wastage of food na him make the new head of house, Peace Ogor quarrel with her fellow housemate, Beatrice.

Na who see food for BBNaija Shine Ya Eye house dey dance.

Pere BBN never finish to hear the full gist, as Kayode shift camera go for the kitchen, na so we see Whitemoney and him gang dey share noodles, Whitemoney BBN dey him zone dey dance and sing and dey cook while Angel dey share food as she and Sammie dey follow dey dance.

Read On: Ifu Enada Movies, Career And Businesses Since BBN

Boma BBN and Angel BBN still dey act drama on top food

As we still dey on the food matter, or lack of food matter na so we dey wonder if big brother intentionally give them small food to distract them from the main issue, wey be the Wildcard wey biggie plant for the Shine Ya eye house. Na so so food matter they bother them. E begin with HOH peace and continue with Angel wey dey quarrel person wey go use four whole spoons of milk for cereal. That person ma, Na wa oo.

Another person dey complain say them wan chop the last bread for house while Boma BBN to never finish understand how person go comfortably dey eat fried rice and bread. Boma no go Borden House for Naija na why food combination

Recent Posts

50 Cent Hints Jay- Z Documentary After Jay-Z Epstein Allegations

The controversial collection of evidence and information allegedly gathered by disgraced businessman Jeffrey Epstein continues…

20 hours ago

Grammy Awards 2026 Winners List: Kendrick Lamar Ties Jay-Z’s Record as Fela Kuti, Nigerian Artists Win

It was announced earlier that Fela Kuti will receive a posthumous Grammy Award for Lifetime…

1 day ago

Grammy Awards 2026: Nigerian Winners, Nominees and How to Watch Live in Nigeria

The 2026 Grammy Awards is set to hold today, February 1, 2026, and several music…

2 days ago

10 Most Popular Couples in Nigeria

Several popular couples in Nigeria didn’t quite make it till the end of the year,…

2 weeks ago

Hilda Baci Becomes a Three-Time Guinness World Record Breaker

Celebrity chef Hilda Baci has kicked off 2026 on a high note after becoming a…

2 weeks ago

Learn How to Get A Remote Job In Nigeria

We have created a practical, step‑by‑step guide specifically for Nigerians who want legitimate remote jobs…

2 weeks ago