Categories: Revamp

BBnaija Shine ya Eye: Wetin I wan see for BBNaija Shine ya Eye.

BBnaija shine ya Eye dey begin today, but before we go into the show proper, make we first discuss the things wey we don really miss and the things wey we no fit wait to see like

Wetin and wetin Ebuka go wear come hold ground for BBnaija shine ya Eye.

Everybody wey dey watch BBN know say Ebuka no dey ever fall hand for him fashion, cloths they really make sense for him body and me personally no fit wait to see wetin him go wear as this season of BBNaija.

Na how biggie wan take show him housemates original miango pepper this season?

Una remember when big brother bring NiaMa NiaMa come for Tboss them make them chop? Biggie even do something similar to the Cee-C and alex Unusual them. Even though, biggie free them Erica and Laycon them, (My mind the tell me say na because of lockdown them no see where to buy Niama NiaMa ).

I no know why people think say biggie house na for them to find love. For the last seasons, the normal triangle don wash, na pentagon, cube and parallelogram them dey draw. Which member of the gang wan fall in love abeg? And make them fall well abeg. Na who no shine him eye go over do love for this BBnaija shine ya Eye.

We no know where Ebuka the pack him lie lie pidgin english proverb from oo

Ebuka dey like to drop one or two words of wisdom for my native language and even though we no sabi where him dey pack them from, we sha, appreciate say him dey represent wella.

Na only for BBnaija shine ya Eye house money dey for lagos

You know say Zlatan Ibile do be talk say money no dey Lagos, but the way wey biggie dey take arrange him house like heaven ehn..? as if na only for that house money dey and we no fit wait to see the new decorations wey biggie go install for him mansion.

Biggie task and sponsor task for BBnaija shine ya Eye Housemate

Una remember how Kiddwaya destroy that Opor Opor challenge? Me personally dey seriously pray make people wey no suppose dey sing; sing well well for this season of Naija shine ya Eye. Memes don dey finish for internet.

Recent Posts

50 Cent Hints Jay- Z Documentary After Jay-Z Epstein Allegations

The controversial collection of evidence and information allegedly gathered by disgraced businessman Jeffrey Epstein continues…

20 hours ago

Grammy Awards 2026 Winners List: Kendrick Lamar Ties Jay-Z’s Record as Fela Kuti, Nigerian Artists Win

It was announced earlier that Fela Kuti will receive a posthumous Grammy Award for Lifetime…

2 days ago

Grammy Awards 2026: Nigerian Winners, Nominees and How to Watch Live in Nigeria

The 2026 Grammy Awards is set to hold today, February 1, 2026, and several music…

2 days ago

10 Most Popular Couples in Nigeria

Several popular couples in Nigeria didn’t quite make it till the end of the year,…

2 weeks ago

Hilda Baci Becomes a Three-Time Guinness World Record Breaker

Celebrity chef Hilda Baci has kicked off 2026 on a high note after becoming a…

2 weeks ago

Learn How to Get A Remote Job In Nigeria

We have created a practical, step‑by‑step guide specifically for Nigerians who want legitimate remote jobs…

2 weeks ago