BBNaija “Shine Ya Eye” Commentator, na for here we dey dissect all the happenings and kasala wey go happen for the new 2021 BBNaija “Shine Ya Eye”.
Here na some of the thing wey you suppose they expect from my happenings “Shine Ya Eye” Commentator page:
- This original BBNaija “Shine Ya Eye” Commentator go dey yab some of the BBnaija ‘Shine Ya Eyes’ housemates from time to time. No be like bad yab oo… we go just de catch cruise from their actions in za house.
- We go dey follow ebuka back to back. we go follow yab Ebuka. Even though the host of the BBNaija “Shine Ya Eye”.
Follow BBNaija Shine Ya Eye Commentator to fine how the wild card love between Maria and Pere wan take survive, even though maria don already say she no like how Pere BBN mark ‘am as him own con go the kiss another housemate with passion. Na that passionate kiss matter nahim we still dey solve oo. Na the same kiss matter m ak Maria BBN curse curse Pere, although, with the way wey she been dey Blush during the insult session, e fit be say na love she dey show.
Una know say Sammie BBN don been talk say him want make Peace BBN be him own, But as a Sharp Gel, Peace don quick quick dismiss that him yeye talk. Him no know say peace no be bread or polo wey person dey carry do property. na matters like this BBNaija “Shine Ya Eye” Commentator go dey commentate on top.
The Wild Card Jonnie for BBNaija Shine Ya eye.
All the Shine Ya Eye housemates believe, say na Beatrice be the wildcard especially the Wildcards themselves and the Head of House Peace Ogor. According to Peace, she says Beatrice dey always shake when them dey talk about the wild card matter, and Beatrice don they shake from the beginning of the show.
Even though them don discover the wild card and Maria BBN and Pere BBN don enjoy the benefit of the good head, the wild card matter still they on, because Pere tell Maria say him like her and Marie say She no like am, but she come dey do somehow.
BBNaija “Shine Ya Eye” Commentator